Dem don release Hushpuppi from prison?

One video wey dey circulate for social media claim sey Ramon Abbas, aka Hushpuppi, don comot prison.

Di video don gada pass 2.2m views, 2,400 retweets, 957 comments and over 7,000 likes for X, former Twitter.

Wetin dem write for di video wey @praiseoghre share tok sey: “Hushpuppi don comot prison, make we hope sey im don learn im lesson”.

For di video, pipu wey resemble Hushpuppi friends dey welcome am for airport as im hold bag. 

Advertisement

Inside di video, some pipu bin dey record am for dia phone as e dey comot from di airport.

Dem don share di video for some pages ontop Facebook, dey claim sey Hushpuppi no dey prison.

WHO BE HUSHPUPPI?

Huspuppi na Nigerian internet celeb wey dey serve 11-year jail term for America sake of “extensive international online fraud”.

Advertisement

Dem tok sey im commit crimes around money laundering, internet fraud, hacking, fake identity, scamming, banking fraud and identity theft worth Dh1.6 billion (around N168 billion).

In June 2020, di Federal Bureau of Investigation (FBI) track and arrest am through im Google account for Dubai, United Arab Emirates (UAE).

Otis D. Wright II, US district judge, sentence di internet celebrity afta dem cari am go America in July 2020.

Wright give am order make im pay back $1,732,841 to two fraud victims, afta im plead guilty to one-count charge of conspiracy to engage in money laundering in April 2021.

Advertisement

Right now, Hushpuppi dey serve im jail term for di Federal Correctional Institution (FCI) in Fort Dix, New Jersey.

WETIN WE CHECK

Advertisement

Keyword search show sey di video first comot for YouTube in 2018 by iLiteTV, during Hushpuppi birthday for Cyprus.

Di video comot again for YouTube in 2020 afta dem arrest am, make e be like sey dem release di internet celebrity from prison.

Advertisement

To check where Hushpuppi currently dey, TheCable still check di inmates register of di US Federal Bureau of Prisons.

Di register get di details of inmates including dia name, age, location and dia release date.

Advertisement

Di search results show sey Hushpuppi currently dey Fort Dix Federal Correctional Institution and im release date na April 2029.

FINAL TOK

Di claims wey tok sey Hushpuppi don comot prison no correct. Di viral clip wey be like sey e don comot na old video from 2018. 

Based on records from di US Federal Bureau of Prisons, di internet celebrity still dey prison dey serve im 11-year jail term.

Logo-favicon

Sign up to receive the latest local, national & international Criminal Justice News in your inbox, everyday.

We don’t spam! Read our [link]privacy policy[/link] for more info.

Sign up today to receive the latest local, national & international Criminal Justice News in your inbox, everyday.

We don’t spam! Read our privacy policy for more info.

This post was originally published on this site be sure to check out more of their content.